15 Den I tell Israel pipol, “God don tok! So make una dey honbol and listin to am!
Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church.’ ”
If una put una body down for God, E go karry una go up.
But God take mi from di shepad work wey I dey do kon sey make I go profesai to en pipol, Israel.
Una wey bi leaders, make una listin! Evribody wey dey stay dis land, make una listin well-well. Anytin like dis don ever happen for una time or for una grand-grand papa dem time?
But make una know sey, if una kill mi, una and di pipol for dis town nor go get rest, bikos una don kill innocent pesin wey God send kom warn una.”
Naw, who among una go gri listin to dis tin? From naw go, una go gri listin with kare?
God hate pipol wey dey karry body up; E nor go let dem eskape en ponishment.
“Na so I go take distroy Judah and Jerusalem pipol pride.
Heaven and eart, make una listin to wetin God tok: “Di shidren wey I train by mysef don turn against mi.