Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 10:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 So make una listin! One news dey kom naw! Wahala dey kom from di nashons for nort! Dia sojas don skata and turn Judah town to desert where animals dey stay.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 10:22
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

God sey, “I go pak dirty full Jerusalem and jackals go dey stay der, den I go turn Judah town to desert where nobody dey stay.”


kon rijet Esau, en broda. I distroy Esau hill kountry kon turn dia land to where dem dey trowey dirty put and naw, na wild animals dey stay der.”


“God sey, ‘Si, sojas dey kom from one land for nort; one nashon wey dey far and dem dey ready to kom fight.


Benjamin pipol, make una run for una life! Make una run komot from Jerusalem! Make una blow trumpet for Tekoa kon put sign for Bet-Hakkerem, bikos wahala and distroshon dey kom from nort.


God sey, “Israel pipol, make una listin! I dey bring enemies kom from far kountry kon attack una. Na kountry wey strong well-well; wey I kreate since; kountry wey una nor know or undastand dia language.


Show dem where dem go pass run go Zion. Make dem run kwik-kwik, so dat dem go dey save! Bikos God dey bring wahala kom from nort and E go distroy well-well.


All di sojas for nort, I go soon koll dem kom attack Jerusalem. Dia kings go build dia throne for Jerusalem gate kon distroy all di walls wey dey guide di town. Den dem go attack all di towns for Judah.


Shuku-shuku go grow full dia farms; jackals and owls go dey stay for di town.


So God tell mi, “Dis mean sey, na from nort I go start to distroy kom and I go distroy evribody wey dey di land.


From Dan town, one vois dey shaut dey kom and e dey bring bad news kom from Efraim hill.


‘I go koll di pipol wey dey nort and my savant King Nebukadnezzar for Babilon and dem go kom fight against Judah pipol and di towns wey dey round Jerusalem. I go distroy and skata dis nashon and di ones wey dey round am, forever. I go make pipol si and dey fear dem.


Hazor go turn desert forever and na only jackals go dey stay der. Nobody go ever stay der again.” ’ Mi, wey bi God, don tok.”


Jerusalem road dey mourn, bikos nobody dey pass der go celebrate again. Di town gate kwayet and pain won kill di priests dem. Di yong wimen dey kry, bikos di trobol wey dem dey face, too mush!


Den make yu tell di pipol for di land sey, ‘Dis na wetin God tok about una wey dey stay for Jerusalem and Israel. Una go chop una bread with pain kon drink wota with fear. Bikos of di wahala wey una kause, I go take evritin wey dey una land.


Di enemies dey shaut like lion as dem dey distroy my pipol; skata dia land and burn di towns with doz wey dey stay der.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka