Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jeremaya 10:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 Dem don distroy awa house and di rope wey bin whole di house togeda, don kut. Dem don karry awa shidren go as slave and dem nor go kom back again, bikos of dat, nobody dey to help us build awa house or hang di curtains again.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jeremaya 10:20
12 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I hear as wahala dey happen for evriwhere! Di whole land don skata finish. Yes! Na wons dem distroy awa tent kon tear awa curtains to pieces.


God sey, “Pipol hear kry and shaut for Rama. Rashel dey kry for en pikin dem wey don die and nor-tin wey pipol tok, fit konfort am.”


Make una make una house big well-well; make en rope and en peg dey strong well-well.


Jerusalem enemies don turn dia oga naw and dem dey prosper, bikos God ponish Jerusalem pipol for di sins wey dem kommit. Dem don katch and take dia shidren go far land.


I stresh heaven kon make di eart foundashon! I tell Jerusalem, ‘Una bi my pipol! I don tish and protet una with my hand.’ ”


Wiked pipol dey die trowey, but doz wey dey fear God, dey get long life.


Una dey si mi naw with una eyes, but una nor go si mi again. Wen una dey look for mi, I go don go.


Nobody dey wey go lead una; nobody among una pipol go hold una for hand.


Una porshu wimen from dia house kon take evritin wey God give dia shidren.


And even doh una enemies sey, ‘Zion nor mean anytin and nobody kare about am,’ I go make una well again kon heal una wound. Mi, wey bi God, don tok.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka