Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jenesis 8:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 But God remember Noah and all di animals wey dey inside di boat. So E make one breeze blow for di eart, den di wota kon dey dry small-small.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jenesis 8:1
35 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Den God sorry for Rashel. E hear en prayer kon make am get belle.


But wen God distroy di town and valley where Lot dey stay. E keep Abraham for en mind kon allow Lot run komot di town.


God hear dia kry and E remember en kovenant wey E make with Abraham, Isaak and Jakob.


Di Pesin wey dey remember and fight for us wen wi dey trobol, bikos en love wey nor dey fail, dey forever,


Di next day, Elkanah and en family wake-up for early morning go woship God, den dem kon go back to dia house for Rama. Elkanah sleep with en wife Hannah and God kon remember am.


So Moses stresh en hand face di sea and God kon divide di sea with strong breeze for nite, den di wota turn to dry land.


My God, wen Yu dey show yor favor to yor pipol, make Yu remember mi; make Yu kom near and save mi.


Naw, Oga God swear with en name sey: “I nor go forget all dis evil tins wey una don do.


My God, I don hear evritin wey Yu do and e sopraiz mi well-well. Even naw for awa time, make Yu still do dat wonderful tin wey Yu do before. Even wen Yu dey vex, make Yu sorry for us.


My God, make Yu remember wetin Edom pipol do wen dem kon distroy and karry Jerusalem pipol komot from dia own land. Dem dey shaut, “Make una skata Jerusalem rish groun! Skata di town rish groun!”


My God, make Yu remember David and all di sofa wey e sofa.


I still provide di wood wey dem go use take burn di ofrin for di rite time and for di first korn and fruit. My God, I beg, make Yu remember mi for good and bless mi.


I give orda sey make Levi pipol go santify demsef, den kon guide di gate to make sure sey dem keep di Sabat Day holy. My Oga God, make Yu still remember mi kon save mi, bikos of yor great love.


My God, make Yu remember dem, bikos dem don spoil di priests work and break di priest and Levi pipol kovenant.


My God, make Yu remember all dis tins wey I don do for yor temple and for yor work.


Bikos en sins don high rish heaven and God go remember dem.


Den di big town divide into three and di nashons kon fall rish groun. So God remember Babilon wey big well-well and E gi-am di cup wey full with en vexnashon wine.


Just as heavy breeze from nort dey bring rain, na so too aproko dey make pesin vex well-well.


“I wish sey Yu go hide mi for where dead body dey; den wen Yu nor dey vex again, Yu go remember mi.


God angel kon tell am, “Wetin make yu beat dis donkey three times? Si, I kom here kon stop yu, bikos wetin yu dey do, I nor like am.


den why yu feel sey I know go sorry for Nineveh town wey dey for darkness? Place where en pipol many pass one hundred and 20,000 and wey get many animals.”


Yor goodness bi like di highest mountin and di way Yu dey judge, klean like river bottom. Yu protet both pipol and animals.


But Yu breath from yor nose and di sea swallow dem. Dem sink like stone inside di big sea.


If una go fight against enemy wey dey attack una, den una must blow di alarm and di trumpet. Mi wey bi God go kon help and save una from una enemies.


Evriwhere go dry if God sey make rain nor fall and river go only flow wen God gi-am wota.


Na God dey rule ova wota and E go bi king forever.


bikos E remember en promise wey E make with en savant, Abraham.


Na mi kommand di sea make e dry and e dry own.


God kommand di river and e kon dry wons; E make all di river dry rish groun. E distroy Bashan and Karmel land and all di trees for Lebanon, dry finish.


and with evritin wey dey alive: all di birds and animals, evritin wey follow yu kom out from di boat.


God go remember and bless us. E go bless Israel pipol and di priests wey bi Aaron shidren-shidren.


Wahala go kom di land and all di rivers go dry finish. But, wetin make all dis tins dey happen? Na bikos juju full di whole land and di pipol love dem well-well.


Dem go cross rof river and I go stop di wave and Nile River go dry finish. Assyria wey bin dey karry body up, go honbol demsef and Egypt wey dey strong, nor go get pawa again.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka