4 Afta Adam born Seth, e still stay for anoda eight hundred years and for dis time, e still born many sons and dotas.
Lamek live for five hundred and ninty five year afta e born Noah and e still get oda shidren.
Metuselah live anoda 700 and eighty-two years afta e born Lamek, en brodas and sistas.
Afta e born Metuselah, Enoch do as God tell am for three hundred years and e get oda sons and dotas.
Jared live for anoda eight hundred years and e get oda sons and dotas.
Kenan live for eight hundred and forty years afta e born Mahalalel and e born oda shidren.
Enosh stay for eight hundred and fifteen years afta e don born Kenan and e born oda shidren.
Seth dey for eight hundred and seven years again and e born some oda sons and dotas.
Make awa sons prosper for dia yong age like betta plant wey dem put fertaliza. Make awa dotas bi like betta pila wey dem karve for palis.
Yes! Shidren na God gift; dem bi reward from awa Oga God.
Wen Arfaxad na thirty-five years, e kon born Shelah.
But yu go get many shidren and dem go many kon full di whole eart.”
Den God bless Noah and en shidren kon tell dem, “Make una born full di eart.
God bless dem kon sey, “Make una born many shidren full di eart and na una go kare for evritin! Na una bi oga ova di birds for di sky, di fish dem for sea and evritin wey God kreate.”
Wen Adam don old rish hundred and thirty years, e kon get one pikin wey bi like am and en name na Seth.
Di total days wey Adam live, na nine hundred and thirty years and e kon die.