Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jenesis 3:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Wen di woman si sey di fruit wey di tree dey produce fine well-well and e good to chop; and e go make pesin get sense well-well, e kon take some of di fruit chop. Di woman still give some to en husband wey dey with am and e kon chop too.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jenesis 3:6
19 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

bikos evritin wey dey inside di world (tins wey human being body wont; tins wey dey hongry pesin to get and to dey karry body up), nor kom from di Papa, but na dis world dem from kom.


And nor bi Adam, Satan deceive. Satan deceive di woman and na so sin take kom dis world.


One day, David wake-up from sleep for aftanoon kon waka go di roof. As e dey waka round for der, e si one woman wey dey baf for en house and e fine well-well.


From di tins wey wi karry from Jeriko, I si one fine klot from Babilon, with two silva koin and one gold wey heavy rish fifty fit. I like dem, so I take dem. I hide dem under di groun for my tent centre.”


But just like Adam, my pipol sef break di kovenant wey I make with dem.


some among God sons kon si as woman fine rish. So dem kon dey marry dem as wife.


God kon sey, “Man pikin, I go remove di strong temple wey bi dia joy and pride. Di temple wey dem dey like to look and visit. I go still take dia shidren komot dia hand.


“Man pikin, na one blow I go take kill di pesin wey yu love pass. Make yu nor tok or kry.


But I dey tell una naw sey, ‘Anybody wey look woman kon get di mind to sleep with am, don already kommit sin for en heart.’


I tell Israel pipol dis message: ‘Una dey happy, bikos of una temple. Una like to dey look and go der, but I go distroy am and di small-small pipol wey una get for Jerusalem go die for war.’


Afta sometaim, en oga wife kon dey like am, den di woman tell am, “Make yu kom sleep with mi.”


God tell Adam, “Yu obey yor wife kon chop from di tree wey I kommand yu sey, ‘Make yu nor chop from.’ “Bikos yu do dis, I curse di groun. Yu go work hard to make di groun bring food till yu die.


Di man ansa, “Di woman wey Yu give mi bring some fruits from di tree and I kon chop am.”


“I don swear with my eye sey I nor go ever look wimen kon sey I won sleep with dem.


Thru-out di seven days wey dem do di party, di woman dey always kry for Samson. But for di sevent day, Samson kon tell am di ansa, bikos e dey always disturb am. Den di woman go tell di pipol.


So di profet wey kom from Judah follow di old profet go en house go chop.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka