11 So Oga God ask am, “Na who tell yu sey yu dey naked? Abi, yu don chop di fruit for di tree wey I sey make yu nor chop?”
Nobody dey good for God eye, bikos e dey obey di law. But na thru di law, wi take know wetin sin mean.
But di Oga God sey, “Wetin yu don do so? Yor broda blood dey kry from groun kon meet mi!
As una dey do all dis tins, I nor tok at-all and una feel sey I nor kare. But naw, I go distroy una kon rite evritin wey I get against una.
Di man ansa, “I hear wen Yu dey waka for di gardin and fear kon katch mi, bikos I nor wear anytin, so I kon hide.”
Di man ansa, “Di woman wey Yu give mi bring some fruits from di tree and I kon chop am.”