Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jenesis 26:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Isaak harvest plenty well-well and e rish hundred times of wetin e plant dat same year, bikos God don bless am.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jenesis 26:12
18 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Stay for dis land. Den I go dey with yu kon bless yu, bikos I go give all dis land to yu and yor shidren-shidren. I go do wetin I promise yor papa Abraham.


But odas fall for betta groun. Dem grow well kon bear oda seeds, some bear rish thirty, some sixty and some hundred.”


So, make yu go plant yor seed for morning and nor stop to work until evening; bikos yu nor know di one wey yu do wey go bring gain for yu; weda na dis one, dat one or di two.


All di seed wey dem plant dey grow well for di eart, so make di Oga awa God, bless us!


God don really bless my oga and e get evritin wey e wont. Oga God don gi-am sheep, kattle, gold, silva, man and woman savants, kamel and donkey.


Abraham don old well-well and God don bless am for evritin.


I dey plant di seed and Apollos dey wota dem, but na God dey make di seed grow.


Nobody go wahala dem wen dem dey plant dia seed. Dia vine go get many fruits; di groun go produce food and rain go always dey fall for dem. I go give all dis blessings to my pipol wey remain.


God bless di remainin days wey Job stay for dis eart pass wen dem born am. Job kom get 14,000 sheep, 6,000 kamel, 2,000 kattle and 1,000 donkey.


True-true, dem nor many wen I kom, but naw, wetin yu get don plenty well-well. God don bless yu for evriwhere wey I for work for yu. But naw, how long e go take before I go do sometin for my own family?”


But some seed fall for betta groun. Dem grow well kon bear oda seeds, some bear rish hundred, some sixty and some thirty.


Food go many for di land and seeds go even dey grow well on-top mountins. Make trees bear betta fruit like di trees for Lebanon and make pipol for di land dey grow well like betta grass for di field.


But di seed wey fall for betta groun, na pesin wey hear and undastand God word. E kom bear fruit wey rish hundred, sixty and thirty.’ ”


so dat yu nor go ponish us, just as wi nor ponish yu, but wi dey always trit yu well, before wi even porshu yu with peace. Naw God don bless yu.”


Wen God bless pesin, e dey get enough and nor-tin go make am regret.


Afta Abraham don die, God kon bless en pikin Isaak. Isaak dey stay near Beer Lahai Roi.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka