God tell Moses, “Make yu and di pipol wey yu take komot from Egypt go di land wey I promise Abraham, Isaak and Jakob sey, ‘I go give una shidren-shidren.’
For di time wen Israel neva get king, honga kon dey for Judah land. So one man from Betlehem for Judah kon go stay for Moab and e karry en wife and two sons follow body.
Wen David bi king, strong honga kon dey and e last for three years. So David ask God and E ansa am sey, “Saul and en family dey guilty, bikos dem kill pipol. Dem kill Gibeon pipol.”