Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jenesis 22:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 For early morning di next day, Abraham kon get up go ready en donkey. E take two of en savants follow body plus en pikin, Isaak. Wen e don kut di wood for di ofrin, e kon bigin go di place wey God tell am.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jenesis 22:3
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

So, I go kwik-kwik dey do wetin Yu kommand.


“Anybody wey love en papa, mama and pikin pass mi, nor go fit bi my disciple.


“If anybody kom meet mi and e nor love mi pass en papa, mama, wife, pikin, brodas and sistas, even en ownsef, e nor go fit bi my disciple.


E show mi en pikin, so dat I go fit prish about am give Gentile pipol. I nor go meet anybody make e advise mi


So, anytin wey yu dey do, make yu do am well, bikos wons yu die, yor wisdom, knowledge, work and plans, nor go mean anytin again.


So very early for di next day, Abraham take some food and wota kon give Hagar. E put di food for Hagar shoulder, gi-am en pikin kon sey make dem dey go. So dem go kon dey waka anyhow for Beersheba wildaness.


For dat same day, Abraham obey God kon sekonsaiz en pikin Ishmael and all di oda boys wey dey en house, plus en savants pikin and doz wey dey with am.


Na faith make Abraham obey wen God koll am make e leave en house, travel go anoda land wey God promise am, even doh e nor know where e dey go.


God kon sey, “Make yu take yor pikin Isaak, yor only boy wey yu love and make una dey go Moraya! Den yu go offa am to mi as ofrin for one mountin wey I go show yu.”


For di third day, Abraham kon si di place from far.


Bikos yu don obey mi, evribody go get blessing, bikos I go bless yor shidren-shidren.’ ”


As day just break, Joshua gada di sojas with di leaders for Israel and dem kon mash go Ai for front.


As sun dey shine di next morning, Joshua and Israel pipol komot from Shittim go Jordan River. Dem stay der before dem cross di river.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka