9 But one day, di pikin wey Hagar, Sarah savant wey kom from Egypt, born for Abraham kon dey laf Isaak and Sarah kon si dem,
So Hagar born boy for Abram and en name na Ishmael.
For dat time, di one wey dem born for normal way, trobol di one wey dem born with di Spirit and na so e bi with una naw.
Dem rite am sey, Abraham get two boys, one wey di savant woman born and di oda pikin, na di really wife born am.
Naw, Sarai wey bi Abram wife neva born any pikin, but e get one woman savant from Egypt, wey en name na Hagar.
Even inside en pain, Jerusalem remember wen e nor get money or house to stay. E still remember all di propaty wey e bin get. But naw, en enemies don attack am and nobody gri kom help am. Di way e take fall, dey make en enemies laf.
Even shidren dey show who dem bi with wetin dem dey do; den yu go fit know if dem good and dey honest.
Dia wahala don break my bones. Dem dey laf dey sey, “Where dat yor God dey sef?”
But naw, I don turn worm instead of man. Evribody hate and dey laf mi!
But dem laf God messenjas, rijet en warnin and en profets. At last, God vex for en pipol and nobody fit stop am wen E dey vex.
Di messenja waka from one town to anoda and e go evriwhere for Efraim and Manasseh land, e even rish Zebulun, but di pipol kon dey laf am.
Pipol laf some; flog some; shain some and put odas for prison.
I hear wetin yu tok about Ishmael. I go bless am kon gi-am many shidren. E go bi twelf prince papa and I go make en shidren-shidren great.
“But pipol wey yong pass mi dey laf mi naw! Pipol wey dia papa nor dey yuzful, wey I nor go even allow join di dogs wey dey guide my sheep.
Di pikin grow kon stop to suck. Abraham do betta party for di day wen Isaak stop to suck.
If una porshu proud pipol komot from where una dey, kworel, wahala and bad words, nor go dey again.