Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jenesis 2:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Dis na di story about di heaven and eart wey God kreate.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jenesis 2:4
27 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Dis na di rekord of Adam family. Wen God kreate human being, E make dem just as E bi.


God sey, “Na mi bi di Alfa and Omega, di One wey dey since, wey dey naw and wey go still kom, na mi bi di God Almighty!”


Abi di rain or dew get papa?


Wen di pipol si dis tin, dem fall face groun kon dey sey, “Na God bi di true God! Na God bi di true God!”


Awa Oga sabi fight war, na God bi en name.


Dis na di shidren wey Esau (wey bi Edom) born.


So God si evritin wey E kreate and dem good well-well! And dat evening and morning kon make am di sixt day.


God si sey di lite dey good, so E kon separate di lite from di darkness.


Na who bi God escept God? Na who again bi Solid Rock escept awa God?


kon pray: “My Oga wey bi awa grand-grand papa God, na Yu bi God wey dey for heaven and na Yu dey rule di whole world. Na Yu get all pawa and nobody fit stand against Yu.


Levi shidren akordin to dia rekord na Gershon, Kohat and Merari. (Levi stay for one hundred and thirty-seven years.)


Dis story na about Esau, Edom pipol papa for di hill aria wey dey Seir.


Dis na di story about Abraham pikin Isaak. Abraham na Isaak papa.


Dis na di story about di pikin Ishmael wey Hagar di woman wey kom from Egypt; Sarah savant born give Abraham.


Dis na Shem shidren. Two years afta di rain, wen Shem don rish hundred years, e kon born Arfaxad.


Na dis bi family wey Noah shidren: Shem, Ham and Jafet born, afta di flood happen.


God bless dem kon sey, “Make una born many shidren full di eart and na una go kare for evritin! Na una bi oga ova di birds for di sky, di fish dem for sea and evritin wey God kreate.”


Wen di world just start, na God kreate di heaven and di eart.


Den I hear di angel wey get pawa ova di wota dey sey: “Di Pesin wey dey since, wey dey naw, di Holy One, na yu dey good, bikos yu don judge well.


And dem go sey: “Awa Oga God wey dey mighty, wi dey tank yu. Di one wey dey since and wey go always dey, bikos naw, yu don show yor pawa kon start to rule.


Na John rite dis leta go give di seven church wey dey Asia aria. Make grace and peace dey with una from di Pesin wey dey since, wey dey naw and wey go still kom. From di seven spirits wey dey en throne front


God wey dey rule and protet Israel pipol; di Pesin wey get pawa sey, “Na mi bi di First and di Last; e nor get any oda god apart from mi wey bi di Almighty God.


bikos Yu big well-well and dey do wonderful tins. Na only Yu bi God,


So God kon sey, “Make lite kom.” And lite kon kom!


God bless di sevent day kon make am holy, bikos na dat day E stop all di work wey E dey do since.


“Yu dey der wen I kreate di heavens and eart? If yu know well-well, tell mi about dem.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka