10 So as wota dey flow from Eden go wota di gardin, e dey from der, divide into four river.
Den di angel show mi di river wey dey give life. Di river klear like crystal and e dey pour kom from God and di Lamb throne.
Di wota from di river dey bring joy kom God town; di special and holy place where di Holy One dey stay.
Lot look well-well from Jordan River aria go rish Zoar. E kon know sey evriwhere for der get betta green plant and dem get betta wota like Oga God gardin for Egypt. (Dis na before God distroy Sodom and Gomorrah.)