Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jenesis 17:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 “I make dis kovenant with yu: I promise sey yu go bi many pipol papa.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jenesis 17:4
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Den God tell am, “Na mi bi di God wey get pawa. Yu go dey fruitful and yor propaty go plenty! One nashon; even many nashon go kom from yu and kings go dey join yor shidren-shidren!


“Den I go turn yu to one strong kountry kon bless yu. Yor name go dey great and yu go get betta blessing.


But en papa sey, “My pikin, I know; I know wetin I dey do. Manasseh too go bi strong nashon and e go dey great. But even with all dis, en yonga broda go strong pass am and en shidren-shidren go many like san-san.”


Yu bin sey, ‘I go really do good for yu kon make yor shidren plenty like san-san wey nobody fit kount.’ ”


I go really bless yu kon make yor shidren-shidren plenty well-well and nobody go fit kount dem, just as nobody fit kount stars for sky or di san-san wey dey near river. Yor shidren-shidren go take all di tins wey bilong to dia enemies.


I go make yor shidren-shidren great.” God angel still sey, “Dem go plenty well-well and nobody go fit kount dem.”


And I go make yor shidren-shidren plenty like san-san for di eart and nobody go fit kount dem.


and Oga God kon tell am, “Na two nashons dey yor belle and two pipol go kom out from inside yu. One go dey strong pass di oda one and di senior one, go serve di yonga one.”


I still make kovenant with dem kon promise sey, ‘I go give dem Kanaan pipol land, where dem stay as strenja.’


God wey get pawa well-well go always bless yu! E go make yu dey fruitful kon give yu plenty shidren! Den yu go bi very big nashon.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka