Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jenesis 16:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 So Abram stay for Kanaan for ten years. Sarai wey bi Abram wife kon give Hagar wey bi en savant from Egypt to Abram as wife.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jenesis 16:3
15 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Den Sarai kon tell Abram, “Na yu curse dis wahala for mi! I allow yu make yu sleep with my savant, but as e know sey e don get belle, e nor kom dey respet mi again. Make God judge between yu and mi!”


Hagar bi like Mount Sinai for Arabia kountry and na di same with Jerusalem wey dey naw, bikos e dey inside der as slave with en pikin.


Solomon marry 700 wife kon get 300 girl-friends and na dem make am turn en heart from God.


Wen David don komot from Hebron go Jerusalem, e kon get many wifes, girl-friends and shidren.


As Israel dey for di land, Reuben kon go sleep with Bilhah, en papa girl-friend and Israel kon hear wetin happen. Jakob get twelf sons:


For nite, Jakob kwik-kwik take en two wife, en two savant and en eleven shidren kon go Jabbok wotaside.


Wen Leah si sey e nor fit born again, e kon give en savant Zilpah to Jakob.


So Rashel give en savant Bilhah to Jakob and Jakob kon sleep with am.


So Esau go Ishmael kon marry Mahalat wey bi Nebaiot sista and na Ishmael, Abraham pikin born am. E marry dis one join di wifes wey e get before.


But wen Abraham still dey alive, e give gift to di shidren wey en oda wifes born for am kon send dem go east, so dat dem go dey fast and nor disturb Isaak.


Abram sleep with Hagar and e kon get belle. As Hagar know sey e don get belle, e nor kon dey respet Sarai again.


Dat time, Abram na eighty-six years.


E stay for Paran wildaness. En mama go Egypt go bring wife kom for am.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka