Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jenesis 11:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Den dem tell each oda sey, “Make wi do stone kon bake dem make dem for strong well-well.” So dem do strong stone wey dem go take build.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jenesis 11:3
19 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Naw, Siddim Valley get some portor-portor. Wen Sodom and Gomorrah king dey run, some for en men kon fall enter di pit, while di rest, run go di hills.


but as e nor fit hide am again, e take basket wey dem make with soft wood kon wrap am, so dat wota nor go enter inside. E put di pikin inside kon put am near di grass dem wey dey River Nile korna.


Egypt pipol make life taya Israel pipol with di kind hard work wey dem dey do with mortar, stones and all di work for di field.


Yu wey get money, make yu listin! Cry make dem hear yor vois, bikos of di bad tins wey go happen to yu.


Make wi always dey tink of how wi go enkourage, love and do good for one anoda.


But make una dey enkourage one anoda evriday, so dat non of una go get bad mind, bikos of sin.


“Di bricks house don fall, but wi go build am with stone again. Dem don kut di sikamore tree, but wi go replace am with cedar wood wey fine well-well.”


David use di town pipol take work well-well with saw, iron hoes and axe, den e force dem make bricks. Na so e do give di pipol wey dey di oda towns for Ammon. Den en and en men kon go back to Jerusalem.


Look, yu wey dey sey, “Today or tumoro, wi go-go dis or dat town go stay der for one year and do business kon get gain,”


Naw, dem dey attack una town, so make una fetch enough wota! Make una defend una town well-well kon make betta stones with mud, den ripair di fence.


Dem dey always make mi vex, as dem dey offa juju sakrifice inside di holy gardin kon burn incense for di stone altars.


Naw, make I tell una wetin I go do to my vineyard: I go remove di fence wey dey round am kon break di wall wey dey protet am. I go let animals chop and mash am anyhow.


I tell mysef, “Make yu go enjoy yorsef, so dat yu go know wetin happiness bi” But I kon si sey, dat one too, dey yuzles.


If dem tell yu sey, “Kom make wi go kill pesin! Make wi just go attack some innocent pipol!” Make yu nor listin to dem.


Dem dey enkourage each oda to do wiked tins and dey plan how to set trap for sekret kon dey make mout sey, “Nobody go ever know or si us!”


So make wi go down go skata dem kon mix dia language, so dat dem nor go undastand each oda.”


Den dem sey, “Naw, make wi build one town wey go high rish di sky, so dat wi go make name for awasef, if not, wi go skata for evriwhere for di eart.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka