Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jenesis 1:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 So God separate di wota wey dey under di space from di wota wey dey on-top di space. And na so e kon bi.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jenesis 1:7
15 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Make di sky, praiz am! Make all di wota wey dey di kloud for up, praiz am!


Di men sopraiz well-well kon dey ask each oda, “Wish kind man bi dis sef? Even breeze and wave dey obey am!”


God sey, “Make di wota wey dey under di sky gada for one place and make dry groun kom out.” And na so e kon bi.


Na God put wota for di kloud and E nor dey let rain fall from di kloud with force.


and make dem bi lite for di sky wey go give lite to di eart.” And na so e kon bi.


If wota full di kloud, den rain must surely fall for di eart and weda tree fall go nort or sout, di tree must stay for where e fall put.


Den God sey, “Make di land produce difren animals akordin to dia kind: kattle, tins wey dey creep for groun and wild animals akordin to dia kind.” And na so e kon bi.


God kon sey, “Make di land produce difren plants: plants wey go bear seeds akordin to how dem bi and trees wey go bear fruit akordin to how dem bi.” And na so e kon bi.


Yu turn springs to rivers and dem even dey flow between mountins.


God koll di space, “Sky.” And dat evening and morning kon make am di sekond day.


Di heavens dey show as God glory bi. Di sky dey show how en work big rish.


Dem dey show am evriday and for evry nite, dem dey show en greatness.


Di Pesin wey make di heaven with en wisdom, bikos en love wey nor dey fail, dey forever.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka