Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Jenesis 1:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 God kon sey, “Make di land produce difren plants: plants wey go bear seeds akordin to how dem bi and trees wey go bear fruit akordin to how dem bi.” And na so e kon bi.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Jenesis 1:11
20 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Wen rain don soak groun and e bear betta fruits for di farmer, dat mean sey God don bless di man.


E kover di heavens with kloud kon make rain fall for di eart, den E make grass grow on-top mountins.


Den God sey, “Evry plant wey dey bear seed and tree wey dey bear fruit, I give dem to una as food.


God kon make difren trees make dem grow for di soil and dem dey good for food. (Naw, di tree wey get life, wey dey make pesin know tins well-well; wey dey good and bad, dey for di gardin centre.)


As plant dey grow from groun, di body go first kom out, den di head go bear fruit and seed go kom out from inside.


If God make grass fine like dis, grass wey una go si today and tumoro dem go trow am for fire, E nor go dress una pass dem? Una faith small well-well o-o.


Even doh food dey kom from di eart, evriwhere under di eart, don skata like wetin fire burn.


E bi like tree wey dem plant near wota; wey dey bear fruit for di korrect time and en leaf nor dey dry. E dey prosper for anytin wey e do.


For dis time, nor-tin don ever grow for di eart, bikos Oga God neva let rain fall and nobody dey wey go klear di groun or plant put.


My brodas and sistas, fig tree go fit bear olive, abi vine fit bear fig? So too, wota wey dey kom out from groun and e taste like salt, nor go fit taste like fresh wota at-all.


Naw sef, dem don put di axe for di tree bottom and any tree wey nor bear betta fruit, dem go kut am trow inside fire.


Dem go bi like tree wey dem plant for near river wey en rut spread enter di wota. Dem nor dey fear wen hot weda kom and dia leaf dey always green; dem nor dey borda if rain nor fall and dem dey always bring fruit.


Den Oga God kommand di man sey, “Yu fit chop from evry tree wey dey di gardin,


Dis na bikos God dey give dem di kind body wey E wont make di plant get.


Di land produce difren plants; di ones wey dey bear seeds and fruits, akordin to dia kind. God kon si sey e dey good.


Just as seed dey take grow, na so God wey bi king, go take save en pipol and all di nashons go praiz am.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka