14 If anybody among una nor well, make e koll di eldas for di church, make dem pray and use oil anoint am for Jesus name.
Dem drive many demon komot from pipol body and pour oil for many pipol wey nor well head kon heal dem.
Publius papa kon get fever and en belle dey pain am. Paul go si am kon heal am.
dem go fit whole snake and if dem drink poizin, e nor go do dem anytin; dem go put dia hand for pipol wey nor well body and di pipol go well.”
But Naaman vex waka komot dey sey, “I bin tink sey e go kom outside kom meet mi, den koll en God name and wave en hand for di diziz, so dat I go well.
Titus! Na dis message make mi leave yu for Krete, so dat yu go kontinue awa work for der and pick new leaders for each town, just as I kommand yu.
Wen dem rish Jerusalem, di whole church with di apostles and di eldas kon welkom dem, den dem tell dem evritin wey God don use dem do.
Wen dem don choose eldas wey go lead di bilivers for di difren-difren church, dem kon pray and fast sey, make God protet dem.
But Pita drive all of dem go outside, den e knee down kon pray. E turn face di dead body kon sey, “Tabita, get up!” Naim di woman open en eye and wen e si Pita, e kon sidan.
So e enter inside di room, klose di door kon pray to God.
Den Elijah liedan on-top di pikin three times dey pray kon sey, “My Oga God, make Yu give dis pikin life again!”
Afta dem don kontribute, dem kon send Banabas and Saul go give di eldas di money wey dem gada.