Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




James 4:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Wen yu ask for sometin, yu nor receive am, bikos yu nor ask well and yu won take am do wetin yu like.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




James 4:3
25 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Na dis tins dey make awa mind strong anytime wey wi kom meet God: bikos if wi ask am for anytin wey dey good for en eye, E go give us.


and anytin wey wi ask from am, E go give us, bikos wi dey do wetin E wont and na dis tins dey make belle sweet am.


Wetin dey make una kworel and fight? Nor bi di tins wey dey hongry una to do?


But wen una dey trobol, una go kom beg God make E help una! Una dey espect sey God go ansa una? Afta all di wiked tins wey una don do, God nor go even look una face!”


God hate wiked pipol sakrifice, but E dey enjoy good pipol prayers.


If yu nor gri listin to poor pipol kry, dem nor go hear yor own kry for help.


Dem dey kry for help, but God nor dey ansa dem, bikos dem too proud and dem dey do bad tins.


“Bikos dem nor gri listin wen I tok to dem, na so too I nor go listin anytime wey dem pray to mi.


“Afta sometaim, di yong boy karry evritin wey e get travel go one far kountry kon waste all en money for yeye life.


Jesus ask dem, “Una know wetin una dey ask for so? Una go fit drink from di cup wey I go drink from? Abi una go fit bear di baptizim wey dem go baptize mi?”


Jesus ask dem again, “Una know wetin una dey ask for so? Una go fit drink from di cup wey I won drink from?” Dem ansa, “Yes! Wi go fit.”


So, Jeremaya my profet! Make yu nor pray or beg mi bikos of dis pipol. Wen dem dey trobol, make dem nor koll mi for help, bikos I nor go listin to dem.”


God nor like wen wiked pipol dey offa sakrifice gi-am, bikos dem dey do am with bad belle.


Dat time, una go koll mi wey bi wisdom, but I nor go ansa. Una fit go find mi for evriwhere, but una nor go si mi.


Even if dem fast, I nor go listin to dia kry for help and if dem offa burnt and korn ofrin, I nor go asept am. Instead I go kill dem for war and with diziz and honga.”


Wen dem koll pipol to help dem, nobody gri kom. Dem even kry to God, but E nor gri ansa dem.


So, mi wey bi God sey: ‘I go soon distroy dem and dem nor go fit eskape. I nor go listin to dem wen dem kry kom meet mi for help.’


But wen dis yor pikin kom back afta e don waste all yor money with ashawo, yu kon kill di melu wey fat pass for am!’


so E tell am, “Bikos yu don ask for wisdom to rule well, instead of long life, propaty or make yor enemies die,


Bikos pesin wey ask, go get, pesin wey find, go si wetin e dey find and di pesin wey nok, di door go open for am.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka