Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




James 4:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 but yu nor know tumoro. Wetin yor life bi like? Yu bi like smoke wey dey kom out from fire. Pipol go si am, den small time e go vanish.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




James 4:14
17 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Human being bi like grass and wetin make am fine, bi like flower; di grass go dry and di flower go die,


Si! Yu don make my life short well-well and my whole life bi like one sekond to Yu. True-true, evribody life just bi like breeze wey dey blow pass.”


And dis world don dey fade with di tins wey pipol wont, but di pesin wey dey do wetin God wont, go dey forever.


Bikos my days dey disappear like smoke and my bones dey hot like wetin fire dey burn.


But pesin wey get money, make e nor proud, bikos e go soon perish like flower wey dey for bush.


Make Yu remember how my life short rish and how human being life empty and nor mean anytin!


Di time wen evritin go end don near. So make una dey kontrol unasef and shine una eye wen una dey pray.


Dem skata where I dey stay won kon take my life like tent wey dem pul from groun; like klot wey dem kut komot from machine. Yes! I bin tink sey God won end my life.


bikos E remember sey na ordinary human being dem bi. Dem go just die go like breeze wey nor dey kom back again.


Wi just bi like air wey dem dey breath; awa days bi like shadow wey dey fade go.


Make yu nor boast about tumoro, bikos yu nor know wetin go happen between naw and den.


So make una stop to trust human being, bikos dem just dey breath thru dia nose. Wetin dis pipol bi sef? So make una stop to trust human being pawa. All of dem go die one day, so how dem won take help una?


But Barzillai ansa. “I nor go dey dis life tey again, why I go follow my king go Jerusalem?


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka