Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




James 3:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 Pipol wey nor like trobol, dey plant fruit wey dey bring raitiousness.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




James 3:18
13 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

God go bless una wey dey make peace, pipol go koll una God shidren.


I sey, ‘Make una plant raitiousness for unasef, den una go harvest love wey nor dey end. Make una klear new groun for unasef, bikos dis na di time to turn kom meet mi, so dat I go save una.’


Make di work wey Christ do for us and how to please God, full una mind. Den all di glory and praiz go bi God own.


bikos di pesin wey dey live akordin to en flesh, go reap bad tins, but di pesin wey dey live akordin to God Spirit, go reap life wey nor dey end.


Raitious pipol fruit bi like tree wey dey give life, but pesin wey dey prish give odas to turn kom meet God, get sense.


No ponishment dey sweet pesin wen dem dey ponish am, bikos e dey pain. But di pesin wey God ponish, go get life wey nor dey end.


Wiked pipol nor get gain for anytin, but reward dey for who dey do di korrect tin.


Human being vexnashon nor dey make pipol live di life wey God wont.


God go reward di pesin wey plok plenty fruit from wetin odas plant and e go get life wey nor dey end. So, di pesin wey plant and di pesin wey plok wetin dem plant, go happy togeda.


Horse fit run well on-top rock? Abi human being fit ride horse on-top wota? Yet, una don turn bitter judgement to poizin and good to bad.


Doz wey trust dia propaty, go fall like wetin harmattan breeze blow; but raitious pipol go prosper well-well, dem go bi like sun wey dey shine.


Dem go still dey produce fruit for old age! Dem go dey strong and fresh well-well.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka