Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




James 2:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Or dem nor dey tok bad about Jesus name wey una bilive?

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




James 2:7
23 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

e si mi as good pesin kon choose mi to serve am. But God sorry for mi, bikos den I nor know wetin I dey do and I nor bilive en gospel.


and wen e si am, e kon take am go Antiok. Banabas and Saul stay der for one year dey tish di pipol wey dey di church and na for der dem for first koll di disciples, “Christians.”


E diliver en pipol kon make sure sey en kovenant go dey forever. Make una si as en name dey holy and big!


For en klot and lap, wetin dem rite put na: “King and Oga God wey big pass.”


E wear klot wey dem soak inside blood and di name wey dem dey koll am, na God Word.


where all di family for heaven and eart from get dia names.


I ponish dem many times for all di sinagog and I try to force dem make dem curse God. Bikos dat time, I dey vex for dem well-well, I even travel go oda towns go sofa dem, bikos of wetin dem bilive.


And na en pawa God dey use save pipol, bikos for di whole world, e nor get any oda name wey get pawa to save pipol, like Jesus Christ own.”


But wen di Farisee pipol hear wetin dem dey tok, dem kon ansa, “Na Belzibub (wey bi demon oga) pawa e dey use take drive demons komot from pipol body.”


“Si! Di woman wey neva sleep with man before go get belle and e go born boy and dem go koll am, ‘Emmanuel’ wey mean, ‘God dey with us.’ ”


Wen e bikom king, Judah pipol go dey save and Israel pipol go stay for peace. Dem go koll am, ‘Na God bi awa raitiousness.’ ”


Di pipol wey I choose go use una name as curse. Mi, God wey bi king, go kill una. But I go give new name to pipol wey obey mi.


So, God go give una sign by ensef. One yong woman wey neva ever sleep with man before, go get belle kon born boy pikin and dem go koll am, ‘Immanuel, wey mean, “God dey with us.” ’


Si as yor perfume dey scent well-well and yor name bi like di perfume wey fine pass. No wonder wimen love yu well-well!


dey sey, “Oga God, wi remember sey wen dat wayo man still dey for dis world, e tok sey, ‘Afta three days, e go wake-up.’


Dem bi my own pipol and I kreate dem, so dat dem go give mi glory.”


so evribody go kom meet God, plus Gentile pipol wey I don koll to bi my pipol.’ God wey make all dis tins, na so E tok


But if yu sofa bikos yu bi Christian, make yu nor shame, but dey praiz God, bikos yu dey ansa Jesus name.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka