Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




James 1:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 My brodas and sistas, make una dey happy wen una dey face temptashon,

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




James 1:2
21 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Di pesin wey fit bear wen problem kom meet am, make e happy, bikos e don show sey en faith strong and e go get di crown wey get life, wey God don promise sey E go give pipol wey love am.


God don give una dis sign, nor bi only make una for bilive Christ, but make una for still sofa for am,


If God do all dis tins, den E know how to save en pipol from trobol kon tie wiked pipol keep, so dat E go ponish dem wen E go judge di world.


I dey happy for di sofa wey I dey sofa for una and for di church wey bi Christ body, so I dey take my body komplete wetin remain for Christ sofa.


Make yu nor fear di tins wey yu go soon sofa. Devil go trow some of una inside prison, so dat e go test una. Yu go sofa for ten days. But make yu nor live mi, even if e mean sey yu go die. Bikos I go give yu di crown wey bi life.


So di apostles komot from der dey happy well-well sey God don give dem di shance to sofa, bikos of Jesus Christ.


True-true, una sofa like oda prisonas and una dey happy wen dem seize all una propaty, bikos una know sey una get betta tin wey go last forever.


But even if dem take mi offa sakrifice for una, I go dey happy,


Wi still dey happy inside di wahala wey wi dey face, bikos wi know sey trobol go make us endure,


My brodas and sistas, make nor-tin deceive una,


My brodas and sistas, make una undastand dis tins: Make una dey listin well-well and nor dey kwik tok or vex.


Make una tink of how wi dey look pipol wey get patient sey, God don bless dem. Una hear how Job get patient and how God bless am leta. God get mesi and E dey sorry for pesin well-well.


so make una kom follow mi rijoice.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka