Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




James 1:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 As sun dey dry grass and flower and dia beauti dey die forever, na so rish pesin go dry, as e dey porshu and love money.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




James 1:11
27 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Wen sun kom out, e burn di plant, bikos dem nor get deep rut, dem kon die.


So wen sun kom out, e burn dem and bikos dia rut nor deep well, dem kon die.


So wen di big shepad, Jesus Christ go kom, e go give una crown wey en glory nor go ever fade.


Dem born us put for inheritance wey nor dey spoil, dirty or fade. God keep di inheritance for heaven for us


E nor go make any difrence even if yu get all di tins for dis world or sey yu like di world well-well, bikos as wi know, di world go soon vanish komot.


My heart dey weak; my body dey dry go like grass and I nor fit chop anytin.


Food and wota nor go hongry dem again. Sun and desert heat nor go burn dem again, bikos na di pesin wey love dem, go lead dem. E go lead dem go where wota for dey flow.


Di proud leaders glory wey don dey fade, go disappear like di first fig wey kom out for en sizin; pipol go plok dem chop wen dem neva ripe.


Efraim pipol, una own don finish! Una glory dey fade like flower wey breeze blow trowey, bikos una leaders don drink well-well and even with all di perfume wey dem spray, dem still sleep for dirty, bikos di drink don katch dem well-well.


Just as pesin kom out from en mama belle naked, na so too e go-go back naked and e nor go karry anytin follow body.


My life dey pass kwik-kwik like shadow for evening and I dey die go like grass.


Bikos dem go soon die like grass. Just as flower dey die for dry sizin, na so too dem go die trowey.


Wi bi like shadow wey dey waka pass and evritin wey wi dey busy dey work for, nor mean anytin. Wi dey gada money keep and wi nor know who go spend am.


For morning, dem dey grow and shine, but for evening, dem go dry kon die.


Awa days for dis world bi like grass; just as flower dey shine kon die, na so too wi dey shine, but small time wi go die.


If God make grass fine like dis, grass wey una go si today and tumoro dem go trow am for fire, E nor go dress una pass dem? Una faith small well-well o-o.


‘Dis last pipol work for only one hour and wi work for di whole day inside hot sun, but yu pay all of us di same amount.’


Anywhere wey dem hide put, dem dey run komot der, bikos dem dey fear.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka