Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Isaya 17:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Nobody or town go defend Israel land again and na oda pipol go rule Damaskus. Pipol wey go survive for Siria, dem go disgrace dem like Israel pipol. Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Isaya 17:3
27 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Efraim greatness go fly komot like bird and dem nor go born shidren. Dia wimen nor go get belle at-all.


Before di pikin go big rish to sey, ‘Papa or Mama,’ all Damaskus propaty and di tins wey dem karry from Samaria, Assyria king go kom karry dem go.”


Even before di pikin go know how to rijet evil and choose wetin dey good, doz two kings wey dey make una fear, God go don skata dem with dia pipol.


bikos na Damaskus bi Siria main town and na King Rezin dey rule for der. But na like sixty-five years e go take to skata Israel, and dem go distroy all of dem finish.


And doz wey swear with dat yuzles Samaria juju or with Dan juju name and vow with Beersheba juju, go fall for groun and dem nor go raiz-up again.”


war go kom meet una and all una strong house go skata. Dat day go bi like wen King Shalman fight and distroy Bet-Arbel town kon kill both mama and dia shidren.


Israel pipol bi like oda nashons naw and dem dey yuzles like pot wey break.


Dis tin show sey na so too Israel pipol go dey: dem nor go get king or leader; dem nor go do sakrifice or serve stone again and dem nor go get juju or image wey dem go use take konsult dia gods.


Gomer, Hosea wife kon born anoda pikin, but dis time, na girl. Den God tell Hosea, “Yu go koll dis one, ‘Lo-Ruhamah wey mean: No-pity,’ bikos I nor go show Israel pipol love or forgive dem again.


God tell Hosea, “Make yu koll am ‘Jezrel,’ bikos e nor go tey before I go ponish Israel king, bikos of di pipol wey dia grand-grand papa Jehu kill for Jezrel. I go skata Israel kingdom rish groun.


God sey, “For dat time, Israel pipol pawa go finish and na sofa go bi dia own.


But naw, God sey, “For di next three years, Moab pipol and dia propaty go vanish komot dis eart and na few pipol go survive among all di pipol and dem go dey weak well-well.”


I don win Kalno, Karkemish, Hamat and Arpad towns. Yes, I still win Samaria and Damaskus pipol.


For nine years wen Hoshea dey rule, Assyria king katch Samaria kon karry Israel pipol go Assyria. E keep dem for Halah near Habor (Gozan river) and for Medes town.


Assyria king ansa King Ahaz well; e attack and konker Damaskus. E karry di pipol go Kir kon kill King Rezin.


Yu don turn di towns to where dem dey trow dirty put. Di place where strenjas for dey save before, nor bi town again and nobody go ribuild am.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka