Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Isaya 13:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 I don give orda to di sojas wey I choose, I go take revensh thru di sojas wey I give pawa to fight and dem go show as I dey vex rish.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Isaya 13:3
20 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

All di nashons wey dey round una, make dem join una as una gada for di valley.” So, my Oga God, make Yu send yor sojas kom!


Evribody wey dey heaven, God pipol, di apostles and profets, make una happy bikos God don judge and kondemn am bikos of una!”


God stresh en hand go di sea kon konker kingdoms, den kommand make dem distroy all di strong town for Kanaan.


Israel pipol, make una happy bikos of di Pesin wey kreate una. Jerusalem pipol, make una praiz God well-well.


God dey use sign take koll pipol from far-far nashon. E dey blow trumpet take koll dem from evriwhere for di world and dem dey gada kom kwik-kwik.


‘I go koll di pipol wey dey nort and my savant King Nebukadnezzar for Babilon and dem go kom fight against Judah pipol and di towns wey dey round Jerusalem. I go distroy and skata dis nashon and di ones wey dey round am, forever. I go make pipol si and dey fear dem.


Make una nor fear or luz hope, bikos of wetin una hear. Dem go dey tok difren tins evry year about fight for di land and dem go sey one king dey fight anoda one.


Even if Babilon klimb go sky kon build strong house for der, I go still send pipol go distroy am. Mi, wey bi God, don tok.”


So make una stand for God wey get pawa front, bikos di wonderful day wen God go judge di world, don near. God don prepare to distroy en pipol and E don choose who go kill dem.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka