But God tell Samuel, “Make yu nor happy, bikos of how en face look, bikos nor bi en I choose. God nor dey si tins di way una dey si am. Pipol dey look pipol from how dem bi for outside, but God dey look pipol from how dem bi for dia heart.”
Wen Israel pipol hear how Solomon take judge di kase, all of dem kon dey respet am, bikos dem know sey na God gi-am di wisdom wey e take dey judge well.
“Oga, I tok to mysef sey yor promise go make mi dey save, bikos di king bi like God angel wey know good from bad. Make God wey bi yor God dey with yu!”
God go judge many pipol kon setol di kworel wey strong nashons get. Den dem go dey use dia swod and spears take dey work for farm. Pipol from difren kountry nor go fight each oda again or train dia pipol to go fight war.