Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Hosea 8:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Na only my pipol choose king and leaders demsef without sey I permit dem. Dem make juju with dia silva and gold; juju wey dey kause wahala for dem.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Hosea 8:4
20 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Dem still dey sin and woship juju wey dem make kon design am with silva. Dem dey sey, “Make una kom sakrifice and kiss dis juju!”


But till naw, e nor ever gri sey na mi gi-am di korn, wine, olive oil and all di silva and gold wey e take dey woship Baal.


E nor only kommit sin like Jeroboam, but e go marry Jezebel wey bi King Etbaal for Sidon, pikin and Ahab still dey woship Baal.


But naw wey una don know am (or abi make I sey God don know una), why una still dey follow all dis weak and yeye pawas? Una won bi dia slave again?


“Na mi bi di good shepad, I know di sheep wey bi my own and dem know mi too.


Afta e don tink am well-well, e make two melu image with gold kon tell en pipol, “Israel pipol, e don tey wen una dey go woship for Jerusalem. Naw, make una si di god wey bring una kom out from Egypt!”


“But e go sey, ‘I nor know where una from kom! Make una nor near mi, una bi wiked pipol!’


If di Oga God wey get di house go lock di door, una go stand for outside dey nok and beg sey, ‘Oga God, make yu let us enter!’ “But e go ansa, ‘I nor know where una from kom.’


“But e ansa dem, ‘No! I nor know una!’


Make una stop all di bad and wiked tins wey una dey do, so dat una go get new mind and heart. Israel pipol, why una like to die?


Dis sin wey e kommit kon make en kingdom skata rish groun.


Pipol fit make dia own gods? No! Wetin dem make, nor bi god at-all.”


King Nebukadnezzar build one gold image. E tall rish ninty fit and na so too e wide rish nine fit. Di king put di image for Dura aria for Babilon.


But e don late well-well, bikos dem don rijet wetin dey good, so dia enemies go porshu dem well-well.


Before-before, wen Efraim pipol dey tok, di oda tribes for Israel dey fear and respet dem. But naw, Efraim pipol dey woship Baal juju and dis tin kon distroy dem.


Na mi vex give una kings and I still vex take dem komot.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka