Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Hosea 2:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 For dat time, na husband yu go dey koll mi instead of yor masta.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Hosea 2:16
12 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Bikos di Pesin wey kreate una, go bi una husband. Na God wey get pawa bi en name. Israel God wey dey holy go save una. Dem dey koll am di God of di whole eart.


E go run follow en lovers, but e nor go fit katch dem. E go find dem, but e nor go si dem. Den e go sey, “I go-go back to my first husband. I betta well-well den wen I dey with am, pass as I dey naw.”


“Pipol wey nor dey faithful, make una kom back kom meet mi, bikos na mi get una. Among una, I go choose one pesin from each town and two pesin from each family, den bring una kom back to Mount Zion.


Make wi happy well-well kon gi-am glory, bikos di Lamb marriage don rish and di pesin wey E won marry, don ready too.”


I dey jealous for una with God jealousy, bikos I promise sey na one man una go marry. Like woman wey nor no man, na so I won give una to Christ.


Di pesin wey won marry new wife naim bi di bridegroom. En friend, wey bi di best man, dey listin to am. E go dey happy well-well wen e hear di bridegroom dey tok. Na dis dey make mi happy and my joy don full.


Den en mind nor gri komot di girl body again. E love di girl kon dey tok to am well.


en boy-friend kon go Betlehem go tok to am make e kom back. E take en savant and two donkey follow body. Wen e rish di girl papa house, di papa kon welkom am.


Rut kon sey, “My oga, yu really dey good to mi, bikos yu don trit mi like yor savant, even doh I nor bi yor savant!”


Give Jerusalem pipol heart. Tell dem sey dem don sofa rish and God don forgive dem dia sins. Yes! I don ponish dem well-well for dia sins.


I go take una enter di wildaness wey dey di nashons and wi go stand face-to-face as I dey judge una.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka