Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Hosea 1:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 God tell Hosea, “Make yu koll am ‘Jezrel,’ bikos e nor go tey before I go ponish Israel king, bikos of di pipol wey dia grand-grand papa Jehu kill for Jezrel. I go skata Israel kingdom rish groun.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Hosea 1:4
32 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

So God tell Hosea, “Make yu koll dis one, ‘Nor bi my pipol (Lo-Ammi),’ bikos Israel pipol nor bi my pipol and I nor bi dia God.”


Gomer, Hosea wife kon born anoda pikin, but dis time, na girl. Den God tell Hosea, “Yu go koll dis one, ‘Lo-Ruhamah wey mean: No-pity,’ bikos I nor go show Israel pipol love or forgive dem again.


Yu dey do as yor sista dey do and I go give yu dis ponishment cup wey I give yor sista make e drink from.”


Dem naked am kon take en shidren komot en hand, den dem kill-am with dia swod. E kon turn who nor get shidren again and dem dey ponish am for evriwhere for di world.


Dis na wetin di Oga wey bi Israel God tok about di rulers wey suppose kare for en pipol: Bikos una nor kare for my pipol and una skata and drive dem komot, I go ponish una for di wiked tins wey una do.


I drive Israel pipol, bikos of dia ashawo life, yet en sista, Judah, nor fear, but e kon join dey do ashawo too.


Bikos dem don born one pikin for us! God don give us boy pikin! E go bi awa ruler and dem go koll am, “Wonderful Advise, Mighty God, Everlastin Fada and di Prince wey bring peace.”


So, God go give una sign by ensef. One yong woman wey neva ever sleep with man before, go get belle kon born boy pikin and dem go koll am, ‘Immanuel, wey mean, “God dey with us.” ’


Wen Pekah dey rule Israel, King Tiglat-Pileser for Assyria kon attack and katch Ijon, Abel-Bet Maaka, Janoah, Kedesh, Hazor, Gilead and Galilee, plus all di aria for Naftali, den e karry di pipol go Assyria.


E go Samaria kon kill all Ahab family wey remain, just as God don tok thru Elijah.


Andru kon bring Simon kom meet Jesus. Wen Jesus si am, e tell am, “Yu bi Simon, John pikin, na Cefas (wey mean Pita) pipol go dey koll yu from today go.”


Zekaraya ask for sometin make e rite put, den e kon rite, “En name na John.” So, all of dem kon sopraiz well-well.


Make yu listin, yu go get belle kon born boy and yu go name am, ‘Jesus.’


But di angel tell am, “Make yu nor fear Zekaraya, bikos God don hear yor prayer. Yor wife Elizabet go born boy pikin for yu and yu go koll am, ‘John.’


E go born boy and yu go koll am ‘Jesus,’ bikos e go save en pipol from dia sin.”


God wey I dey serve go rijet en pipol, bikos dem nor gri listin to am and dem go dey waka up-and-down for difren kountry.


I go make rain fall and korn, grape and olive fruit go grow for di land.


I go ponish am for all doz times wey e forget mi kon dey burn incense give Baal and dey run follow en lovers with all di gold wey e wear. Mi, wey bi God, don tok.


For thirty-eight years wen King Zabud dey rule Judah, Jeroboam pikin, Zekaraya kon bi king for Israel. E rule from Samaria for six mont.


But di next day, afta Pashhur don release mi, I kon tell am, “God nor koll yu Pashhur, but di name wey E give yu na, ‘Fear Dey Evriwhere.’


Dia land na Jezrel, Kesullot, Shunem,


Ahab get seventy sons for Samaria. So Jehu rite and send leta go give di sojas oga and doz wey dey guide Ahab shidren. Dis na wetin e rite for di leta:


So afta sometaim, my wife kon get belle. Wen e don born awa son, God kon tell mi, “Make yu koll am, ‘Kwik karry Make Yu Distroy Fast-fast.’


Mi wey bi God wey get pawa dey look as Israel kingdom dey sin, so I go distroy dem komot for dis eart. But I nor go distroy Jakob shidren-shidren finish.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka