But E promise mi sey, ‘Yor pikin go rule with peace, bikos I go make all en enemies love am. Di pikin name go bi Solomon, bikos for en time, I go give Israel pipol peace kon guide dem.
Dis still show sey God dey rite wen E asept pipol wey bilive Jesus Christ. E dey ponish sinnas, so dat wi go know sey en na God wey nor like sin. Like dis, God show sey en dey rite and anybody wey bilive Jesus Christ, E dey make dem dey rite too.
E go give us peace. Wen Assyria pipol kom attack and break enter awa town, wi go choose seven rulers wey go wosh ova us and eight priests wey go lead us.