Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Hibru 3:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Just as dem dey praiz pesin wey build fine house, pass di house wey e build, na so too Jesus glory betta pass Moses own well-well!

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Hibru 3:3
11 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

All of us na ko-workers for God and na una bi God farm and en buildings.


even doh wi si Jesus wey angels big pass small, e nor too tey before God gi-am glory and honor, bikos e sofa and die for evribody, just as God plan am.


But as God Pikin, Jesus dey faithful for God house. So wi too go get share for di house if wi bilive and get konfident for awa hope wey dey inside Christ.


Na-im bi head for di body wey bi di church and from di biginnin, na-im bi di first-born wey raiz-up from grave, so dat e go bi nomba one for evritin.


And I tell yu, yu bi Pita, wey mean rock and on-top dis rock, I go build my church and di gate for hell nor go fit skata am.


“Na Zerubabel start di temple foundashon and na-im go komplete am. Dat time, una go know sey na Oga God send mi kom.


Di ministry wey dem rite for slate bring deat kom and di glory wey follow am, nor let Israel pipol fit look Moses face. If di glory wey dey Moses face, fade bikos e dey under di law,


Na pesin build evry house, but di pesin wey build evritin, na God.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka