Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Hibru 11:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Na thru faith wi take undastand sey, God kreate evritin with en word. So di tins wey wi dey si so, na God make dem from wetin dem nor dey si.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Hibru 11:3
17 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Na with di word wey God tok, E take kreate di heavens. E breath en word and all di stars for heaven, appear.


Dem don forget sey, na with word God take kreate di heaven before E kreate di eart from wota and na with wota, E take make dis world.


Na God make evritin and if to sey E nor make dem, dem nor for dey dis world at-all.


God word sey, “I don make yu papa for many nashons.” So for God eye, Abraham na awa papa, bikos e get faith for God wey get pawa to raiz pipol wey don die and to kommand tins wey nor dey before, like sey dem dey.


God wey make di world and evritin wey dey inside, wey bi di Oga God for heaven and eart, nor dey stay inside house wey human being build


“Awa Oga and God! Yu dey worthy to receive glory, honor and pawa, bikos na yu kreate evritin as yu wont.”


but naw, E dey tok to us thru en pikin wey get evritin and na thru am, E kreate di world.


So Israel pipol make una tell di oda nashons sey: ‘Nor bi doz gods make di heavens and di eart. So dem go disappear komot from di eart and heavens.’


Wen di world just start, na God kreate di heaven and di eart.


Make una look di sky! Who make di stars wey una dey si? Na-im dey lead dem like sojas. E know how dem plenty rish and E dey koll all of dem by dia name! En pawa big well-well and no one among di stars dey miss.


“Why una won do dis kind tin? Wi too na human being like una! Wi kon tell una di Good News, wey go make una turn from sin kom meet God, wey make heaven, eart, sea and all di tins wey dey inside dem.


Jakob God nor bi like dem; na-im kreate evritin and E don choose Israel as en own pipol. En name na God wey dey mighty.”


Bikos na afta E tok, di world start! As E kommand, di world kon appear at wons.


Di tin wey I dey tok about, na God sekret wisdom wey E choose for us, even before E kreate di world.


bikos God word and prayer don make am klean.


don taste God good work and di betta wey dey kom,


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka