Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Haggai 1:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 So, make una go di mountins go kut wood kon ribuild di temple; den I go dey happy and belle go sweet mi.” Dis na wetin Oga God tok.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Haggai 1:8
21 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

So di pipol give money to take pay doz wey dey mold block with di karpenters. Dem send food, drink and olive oil go Tyre and Sidon, so dat dem go give dem cedar trees from Lebanon. Dem karry di trees pass Joppa wotaside and na King Cyrus for Persia allow dem do all dis tins.


I don choose and santify dis temple, so dat e go bi my permanent house; I go always dey here.


I go shake all di nashons and dem go bring all dia propaty kom dis temple. I go kover dis place with my glory.” Oga God don tok.


God tell am, “I don hear yor prayers. Dis temple wey yu build for mi, I don make am holy for mysef and na der dem go for woship mi forever. I go wosh and kare for am always.


I go meet Israel pipol for der too, bikos my present wey karry glory don make am holy.


Di glory for dis new temple go big pass di old one and na for der I go for give my pipol peace and make dem prosper.” Dis na wetin Oga God, wey dey mighty, tok.


Una go enjoy en propaty like pikin wey dey suck en mama breast. Una go drink beleful bikos of all di tins wey e get.”


Dem go bring pine wood, junipa, cypress and di wood wey fine pass for Lebanon forest kom take build Jerusalem again; so dat my temple go fine and di town go get glory.


Dem go bring all Kedar and Nebaiot sheep kon give una as sakrifice and dem go offa dem for di altar to take make belle sweet God. God temple go get glory pass as e get before.


Make dem build di wall with one layer and make wood dey on-top each layer. Na di pesin wey dey keep di royal money, go pay for evritin.


Afta 408 years wen Israel pipol don komot from Egypt, wey bi di fourt year wen Solomon don dey rule Israel, for di sekond mont wey bi Ziv mont, Solomon kon start to build di temple.


“God wey get pawa sey, ‘Make una tink about wetin dey happen to una naw.’


Naw, make una serve God with all una heart and soul. Make una start to build di temple, so dat una go fit put di Kovenant Box and all di holy tins wey dem take dey serve God, for inside.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka