5 bikos I don hear about di faith and love wey yu get for awa Oga God Jesus Christ and all God pipol,
since wi hear about how una bilive Christ and di love wey una get for God pipol.
So, since I hear about una faith for Christ and how una love all God pipol,
Wen una kollect money from God pipol, I wont make una do as I tell di pipol wey dey di church for Galatia sey make dem do.
Na doz wey dey fear God for dis land, I dey respet pass! I dey happy to si and listin to dem.
Na wetin E kommand bi dis, “Make wi bilive en pikin Jesus Christ name and make wi love each oda, even as E don kommand us.”
I get joy and my heart dey strong bikos of yor love and thru yu, all God pipol heart don strong too.
For Christ, e nor matter weda dem sekonsaiz pesin or not; di only tin wey matter, na faith wey dey work thru love.
Make una give food to God pipol wey dey hongry and make una dey welkom dem for una house.
I dey prish give Jew and Greek pipol sey make dem turn from sin kom meet and serve God and put dia faith for awa Oga God Jesus Christ.
But naw, Timoti don kom meet us afta e si una and e tell us di Good News about di faith and love wey una get. E still tell us sey, una dey always remember and dey hongry to si us, just as wi dey hongry to si una.