Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Filemon 1:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 So my broda, make yu do dis tin for mi bikos of Christ, so dat belle go sweet mi.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Filemon 1:20
14 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Wetin make mi happy well-well na wen I hear sey my shidren dey live akordin to di trut.


I get joy and my heart dey strong bikos of yor love and thru yu, all God pipol heart don strong too.


I dey send am kom back kom meet yu (even doh I love am well-well).


But pesin wey get enough tins and e nor sorry for en broda or sista for Christ wey nor get at-all, na how God love go take dey inside am?


Make una obey una leaders and do evritin wey dem tok, bikos na dem dey kare for una soul and dem go ansa God wen E ask dem how dem do dia work. Make una let dem do am with happiness, nor bi with komplain, bikos una nor go get any betta tin from am.


My brodas, sistas and friends wey I love, I dey hongry to si una, bikos una dey make mi proud. My friends wey I love, make una stand well inside Christ!


God know sey, bikos of Christ love wey dey my heart, I dey miss una well-well.


So, Christ don make awa mind strong. Even as awa heart don strong rish, wi dey happy more-more for Titus wey kom, bikos all of una don let en mind rest.


Bikos if I make una vex, who go make mi dey happy apart from una wey dey vex for mi?


and dem don let belle sweet mi, just as dem make belle sweet una. E good make wi dey tok about pipol like dem.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka