Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Daniel 9:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Wi nor gri listin to yor savants wey bi profets; di ones wey tell awa kings, rulers, grand-grand papa and all di nashon about Yu.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Daniel 9:6
29 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Wi nor dey obey di Oga awa God, bikos wi nor dey live awa life as E sey make wi leave am. Wi even bilive sey di law wey E sey make en savants tell us, nor mean anytin.


Awa grand-grand papa dem, awa kings, leaders and priests nor keep yor law at-all. Dem nor listin to yor kommands and laws.


From awa grand-grand papa time kon rish naw, wi wey bi yor pipol don sin well-well. Na bikos of awa sin, wi, awa kings and priests, fall for strenj kings hand and dem kill, tif and karry us go as prisonas. Dem don disgrace us well-well as wi dey today.


Bikos di pipol wey dey stay for Jerusalem and all di rulers nor know am, so dem kon use wetin dem dey read for Sabat Day, wey di profets tok, take kill-am.


“O! Jerusalem pipol, O! Jerusalem pipol! Una wey kill di profets and stone di pipol wey God send kom meet una! I don dey try to gada una shidren as fawol dey gada en shidren under am, but una nor let mi do am.


“Wi nor go listin to wetin yu tell us sey na God tell yu.


bikos dem nor gri hear my word wey I dey always send go give dem thru my profets.


My savants wey I send kom meet una, make una dey listin to evritin wey dem tell una. I dey always send dem kom meet una, but una nor gri listin to dem.


Una don do all dis tins and even as I tok to una rish, una nor gri listin or ansa wen I koll una make una turn kom meet mi.


Naw, awa God, di One wey dey great, get pawa and dey mighty, di Pesin wey dey keep en kovenant of love wey nor dey fail, make Yu help us as wi dey sofa. Bikos from di time wey Assyria kings first win us kom rish naw, na sofa wi dey sofa: wi and awa kings, leaders, priests, profets, grand-grand papa dem and all awa pipol.


Even as God warn Manasseh and en pipol rish, dem nor gri listin.


Dis tin happen, bikos Israel pipol sin against di Oga wey bi dia God kon break di agriment wey dem make. Dem nor gri listin or obey evritin wey God kommand dem thru Moses, en savant.


But even with all di sin wey wi kommit, Yu still dey forgive and sorry for us.


Bikos of yor love, Yu dey patient with dem for many years. Yu send yor Spirit wey warn dem thru di profets. But yet, dem nor gri listin! So Yu allow oda nashons attack dem again.


But dem nor gri listin or hear mi. Dem dey do wetin dia sturbon and wiked heart sey make dem do. Instead make dem dey betta, dem kon worse pass as dem bi before.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka