Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Daniel 5:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 King Belshazzar do party for en royal men wey rish 1,000 and e kon drink wine togeda with dem.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Daniel 5:1
11 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

and for di third year wen e dey rule, e kon do party for all en ofisas and savants. Di sojas for Persia and Media dey der too, with di ofisas and strong men for di kountries.


But dis na wetin Oga God wey dey lead heaven sojas tell mi, “True-true, as long as dem dey alive, I nor go forgive dem dia sin.” Mi wey bi God wey get pawa, don tok.


For dat time, Oga God wey dey lead heaven sojas kon sey make una dey kry, mourn, shave una hair and wear sak klot.


En enemies bi like dry shuku-shuku for bush. Yes! Dem bi like pesin wey don drink well-well. True-true, fire go burn dem like dry grass.


I go make en ofisas, wise men, leaders and sojas drink anyhow. Dem go sleep and dem nor go wake-up again. Mi, wey bi God, don tok. I bi di Oga God wey dey mighty.


As dem dey hongry, I go prepare food, so dat dem go chop and drink kon happy. Den dem go sleep kon die go like dat.


So e happen sey for di third day, wey bi Fero birtday, e kon do party for all en savants and e sey make dem release both di man wey dey serve am wine and di one wey dey bake.


God sey, “Babilon go skata! En pipol, rulers and wise men, go die finish.


So for dat nite, dem kon kill Belshazzar wey bi Babilon king.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka