Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Daniel 4:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 “Dis na di dream wey mi, King Nebukadnezzar dream. So Belteshazzar, make yu tell mi wetin di dream mean, bikos nobody among di wise men fit tell mi wetin e mean apart from yu, bikos di holy gods spirit dey inside yu.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Daniel 4:18
14 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Si, dem bring di wise men and majishan kom here make dem read wetin dey di wall kon tell mi wetin e mean, but dem nor fit read am tok-less of to know di meaning.


For morning, en mind nor rest, so e sey make dem koll all en majishan, priest, doz wey dey si wetin go happen and juju pipol for Egypt. Fero tell dem en dreams, but nobody fit tell am wetin dem mean.


So di wise men kom, but dem nor fit read wetin dem rite or tell di king wetin e mean.


Fero kon tell Josef, “I dream one kind dream and e nor get anybody wey fit tell mi wetin di dream mean. But I don hear about yu sey yu dey fit tell pipol wetin dia dream mean.”


Before God wey get pawa do anytin, E go first show en plans to di profets, wey bi en savant.


Dem tell di king again, “Abeg! Make yu tell us yor dream and wi go tell yu wetin e mean.”


I go distroy Egypt pipol with fear kon make dia plans yuzles. Dem go-go meet dia juju for help kon tell doz wey don die make dem advise and ansa dem.


Den Josef tell am, “Na wetin yor dream mean bi dis: di three branches na three days.


Any matter wey koncern wisdom and knowledge wey di king ask dem, e dey si sey dia ansa betta well-well pass di ansa wey all di wise men, majik pipol and di pipol wey dey tok wetin go happen for future, dey give.


E don make yu ruler ova human being, animals and birds for dis eart. Na yu bi di head among all gold.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka