For di dream, yu si angel kom out from heaven kon sey, ‘Make una kut and distroy di tree, but make una leave di body for groun. Make una kover am with iron and bronze. Make una leave am for der with di grass, so dat dew wey dey fall from di sky go wet am, den make e stay with animals for bush.’ ”
But dem give di woman two feada like eagle own, so dat e go fly go di place where dem prepare for am for wildaness. For der, dem go kare for am kon protet am from di dragon for three and half years.
Dem go drive yu komot from where human being dey stay and yu go stay with animals. Na seven years yu go take chop grass like melu and yu go sleep for open field where dew go fall for yor body, until yu go know sey na di Most High God get pawa ova evry kingdom and E dey gi-am to anybody wey E like.
Den E tell mi, “Go make dis pipol get strong heart, deaf dia ear and blind dia eyes, so dat dem nor go si, hear or undastand again. If dem bi like dat, dem go turn kom meet mi and I go heal dem.”
Den I hear di man wey wear linen wey dey on-top di river as e raiz en two hand face sky kon swear with God name sey: “Na only three and half years remain; by di time wen God don save en holy pipol from who dey sofa dem, all dis tins go don happen.”
Siria king go-go back go gada many sojas wey plenty pass di first ones. Den for di rite time, e go attack with all en sojas wey dem don prepare well-well.
E go tok against God kon opress anybody wey dey serve God. E go try to shange laws, festivals and di pipol wey dey serve God, go dey under am for three and half years.
Di king ask am too, “Absalom still dey life?” Di savant ansa, “I wish sey wetin happen to am go happen to all yor enemies and all doz wey dey fight yu.”
“Na like dis di matter take end. But for mi, Daniel, my mind kon dey disturb mi well-well and I kon kover my face bikos I dey fear. But I still keep evritin to mysef.”