Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Daniel 3:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 Di king kon tell dem, “But I dey si anoda pesin for der, dem nor tie am and e just dey waka round di fire! Nor-tin don happen to dem! And di nomba four pesin bi like angel!”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Daniel 3:25
20 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Wen una dey pass thru deep wota, I go dey with una. Una go fit handle any wahala wey kom una way. Wen una pass thru fire, e nor go burn una. Di temptashon wey go kom, nor go too hard for una.


But Paul shake di snake komot from en hand enter di fire and nor-tin do am at-all.


dem go fit whole snake and if dem drink poizin, e nor go do dem anytin; dem go put dia hand for pipol wey nor well body and di pipol go well.”


Naw, wen di day rish for God angels to gada before God, Satan follow dem kom too.


Nebukadnezzar kon sey, “I praiz Shadrak, Meshak and Abednego God, bikos na-im send en angel kom diliver en savants wey trust am. Dem nor gri obey di king kommand! Instead make dem bow woship my god, dem risk dia life kon sey, ‘Na only awa God wi go woship.’


Bikos na God angel dey guide mi, na so too E dey protet and guide all di pipol wey dey fear am.


Who go fit do yu bad tin, if yu dey do good?


But even if E nor save us, wi wont make yu know sey, wi nor go serve or woship yor gold image.”


wen doz wey dey stay heaven dey shaut for joy and for morning, di stars dey sing togeda?


and naim bi my only Pikin wey I wake-up from deat with di Holy Spirit pawa.


Di angel ansa am, “Di Holy Spirit pawa go kover yu. So di pikin wey yu go born, go dey holy and dem go koll am God Pikin.


Who don go heaven kom back? Who don ever katch breeze for en hand or wrap wota for klot? Who kreate di whole world? Na who e bi and na wetin bi en pikin name? Make yu tell mi, if yu know!


Di pipol wey I dey send yu go meet, make yu nor fear dem, bikos I go dey with yu and I go save yu. Mi wey bi God, don tok!”


Dem go attack yu, but dem nor go fit win yu, bikos I go dey der to save yu. Mi, wey bi God, don tok.”


I go save yu from wiked pipol and doz wey like trobol.” Mi, wey bi God, don tok.


King Nebukadnezzar get up at wons kon ask, “Shebi na three pipol wi trow inside di fire?” Dem ansa di king, “Yes.”


Di king kon dey happy, so e orda make dem bring Daniel kom out from di pit. Dem bring Daniel out from di pit and e nor get sore for body or any mark, bikos e bilive di God wey e dey serve.


E go save yu from trobol six times and wen e rish di sevent one, evil pipol nor go fit tosh yu.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka