Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Daniel 3:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 King Nebukadnezzar vex well-well and en face kon dey red for Shadrak, Meshak and Abednego. Den e orda sey make dem heat di fire seven time, so dat e go hot well-well.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Daniel 3:19
26 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Wen di king hear wetin dem tok, e vex kon sey make dem go bring di three men kom en front.


I go turn kon ponish una seven times and e go worse pass di ones wey I ponish una before.


Pesin wey dey karry body up and do wayo, nor dey kare about oda pipol.


I go turn against una. Bikos I dey vex, di ponishment wey I go give una go bad seven times pass di ones wey I give una before.


Wen di priest oga dem hear dis tin, dem kon vex well-well and won kill di apostles.


Bikos e dey fear, en face kon dey red and all en body kon dey shake.


True-true, di way Yu dey vex judge human being, go make dem praiz Yu. Yu really dey show as Yu dey vex rish.


“If una kontinue to rijet mi and una nor gri obey mi, I go inkrease una ponishment seven times again.


“If afta all dis tins happen and una nor still obey mi, I go inkrease una ponishment seven times.


As di kansol membas hear all di tins wey Stefen tok, dem kon dey vex well-well.


Di king kon orda sey, “All di pipol wey lie for Daniel head, make dem katch dem, dia wifes and shidren kon trow dem for di lion pit.” Dem nor even rish groun before di lion dem bigin chop dem with dia bones.


But I go gi-am to pipol wey dey opress una; doz wey dey make una liedan for street kon waka on-top una like sey una bi dirty.”


Wise pesin go try make belle dey always sweet di king, bikos if di king vex, somebody fit die put.


Di king vex kon stand up go di gardin, den Haman kon go knee down for di kween front dey beg am, bikos e know sey di king go ponish am.


So Jakob kon si sey Laban nor dey do as e dey do with am before.


Bikos wetin dem tok make di king vex, e kon sey make dem kill and distroy all di wise men wey dey for Babilon.


E sey make strong sojas tie Shadrak, Meshak and Abednego kon trow dem inside di hot fire.


Wen Haman si sey Mordekai nor gri bow or gi-am respet, e vex well-well


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka