Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Daniel 2:40 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

40 Den, di nomba four kingdom go kom and e go strong like iron wey go skata evritin to pieces. E go skata and distroy all di kingdoms wey dey before.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Daniel 2:40
12 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

“As I still dey look for di vishon, di nomba four beast kom out: E get pawa, e wall-wall and pipol dey fear am well-well. En tit dem na iron. E dey distroy and skata anytin kon use en leg take skata wetin remain. E dey difren from all di beast wey first kom and e get ten horn.


If wi let am kontinue like dis, evribody go bilive am and di Roman govnor go kom take di place wey wi dey woship and awa kountry.”


God sey, “Damaskus pipol don too sin, so I go ponish dem naw, bikos dem flog Gilead pipol with stik wey get iron tit.


“ ‘Afta di sixty-two weeks, di Pesin wey God choose, go die and nor-tin go remain. Di ruler wey get pawa pass, go bring sojas kom distroy di town and di temple. Di end go rush kom like wota; e go bring war and distroshon, just as God plan am.


E go dey strong, but nor bi by en own pawa. E go kause strong wahala kon prosper for evritin wey e dey do. E go distroy doz wey get pawa and pipol wey dey serve God.


En leg na iron, but en toe na both iron and san-san.


Una wey bi like iron and bronze, una fit break di iron wey dey nort?


E send breeze kom attack and wound mi, even doh I nor do any bad tin.


But afta yu, anoda kingdom go kom, dem nor go get pawa rish yor own and afta dat one, di third kingdom wey bi bronze, wey go rule di whole eart, go kom.


Yorsef si di leg and di toe wey dem make with iron and san-san. Dis one mean kingdom wey divide into two. Some of en pawa go bi like iron, aldo dem mix di iron with san.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka