Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Daniel 2:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 kon sey, “Make wi praiz God name forever and ever, bikos na-im get wisdom and pawa.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Daniel 2:20
25 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Make praiz bi God name naw and forever!


But God get wisdom and pawa. E know and undastand many tins.


All of dem kon dey sing with loud vois sey: “Di Lamb wey dem kill, make glory, pawa, propaty, wisdom and honor, bi en own!”


Yu dey make betta plan kon do mighty tins. Yu know evritin wey pipol dey do and Yu dey reward dem akordin to wetin dem do.


Si as awa Oga God big rish! En pawa dey wonderful! Nobody fit undastand how God take dey know tins!


Naw, make all glory bi God own, bikos E nor let una fall and E go bring una kom en present with betta joy wey nor get fault.


Kommon sense and suksess na my own. Na mi get undastandin and pawa.


But wi go praiz God both naw and forever! So make wi praiz di Oga wey bi awa God!


“Make wi praiz God wey don give en pipol peace, just as E sey E go do. E don do all di tins wey E promise Moses en savant.


Nor allow us enter temptashon, but make yu save us from bad tins.’


God don tok many times sey, “All di pawa for heaven and eart, dey my hand


But to dey give tanks, na di kind sakrifice wey dey sweet mi for body. So if una follow my kommand, I go show una how God salvashon bi.”


So make una praiz di Oga wey bi Israel God, bikos E dey alive forever and ever. Amen!


Jehoshafat go meet en pipol kon choose doz wey go dey sing and praiz God wey dey holy. As dem dey mash go meet di sojas, dem kon dey sey, “Make wi tank God, bikos en love na forever and ever.”


Den David kommand en pipol, “Make una praiz di Oga wey bi una God!” And all di pipol praiz di Oga wey bi dia papa God kon bow honor en and di king.


Make all praiz bi di Most High God own, di one wey diliver yor enemies put for yor hand.” Abram kon give Melkizedek one out of evry ten tin wey e bring kom back from di war.


Make una praiz God! Una wey bi God savants, make una praiz am!


Si, yu tink sey yu wise pass Daniel and nobody fit hide anytin from yu?


Levi pipol: Jeshua, Kadmiel, Bani, Hashabneaya, Sherebaya, Hodaya, Shebanaya and Petahaya kon tell di pipol sey, “Make una stand praiz di Oga una God bikos E dey forever and ever!” Den dem pray sey, “Wi go praiz yor holy name! Make yor name high pass evry blessing and praiz!


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka