Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Daniel 2:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 For nite, God show and tell Daniel evritin thru dream. Den Daniel praiz God wey dey heaven

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Daniel 2:19
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

God tell dem, “Make una listin to mi: “If anybody bi profet among una, mi God go show mysef to am thru vishon kon tok with am for dream.


Before God wey get pawa do anytin, E go first show en plans to di profets, wey bi en savant.


“As I still dey look for di vishon, di nomba four beast kom out: E get pawa, e wall-wall and pipol dey fear am well-well. En tit dem na iron. E dey distroy and skata anytin kon use en leg take skata wetin remain. E dey difren from all di beast wey first kom and e get ten horn.


God na friend to doz wey dey fear am and E dey tish dem en kovenant.


God kon give dis four men good sense; difren gift and wisdom. God give Daniel di gift to take tell pipol wetin vishon and dreams, mean.


E kom tell mi like sey na dream for nite wen evribody dey sleep.


“Belteshazzar, na yu bi di majishan dem oga; I know sey di gods spirit dey inside yu and e nor get any dream or vishon wey yu nor know en meaning. I go tell yu my dream and yu go tell mi wetin e mean!


All di sekret tins wey dem hide, E dey bring am out; E know wetin dem hide for darkness and na lite E take kover ensef.


Wen dem tell Israel pipol evritin, belle sweet dem and dem kon tank God. Dem nor ever tok again sey dem go distroy Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe.


Wen dem sey make dem leave di tree body for groun, e mean sey dem go give yu back yor kingdom wen yu don know sey na God bi Oga of all ogas for dis world.


Daniel sey: “As I dey dream dat nite, I kon si breeze dey blow from di four korna for di eart and di sea dey make strong nois.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka