“But Daniel, make yu klose and keep di book for sekret until dis world don end. Many pipol go waste dia strent dey waka up-and-down, bikos dem nor fit undastand wetin dey happen.”
I dey ready to rite wen di seven tundas dey tok, but I hear one vois from heaven dey sey, “Anytin wey di seven tundas tok, make yu keep am as sekret and nor rite dem at-all.”
To una, evritin wey di profet tok, bi like word wey dem rite for book kon klose am. Wen dem gi-am to pesin wey sabi read kon sey, “Read am,” e go ansa, “I nor fit, bikos dem klose am.”
“Wen di end don rish, Egypt king go attack am. Siria king go fight am with all en pawa; with shariot and many ship. E go attack and distroy many kountries like river wey flow enter land.