8 E go karry dia juju and all dia betta tins with silva and gold go back to Egypt. Afta many years wey peace don dey,
e burn all dia gods wey nor bi god at-all, bikos dem bi image wey human being use dia hands make.
Even doh Israel dey grow like betta grass, I go send hot desert breeze from east kom dry dia rivers and well. E go distroy evritin wey dem value.
Na una Israel pipol karve di juju by unasef. Di juju nor bi god! Di gold melu wey una dey woship for Samaria, go skata to pieces!
I nor chop any good food, meat, drink wine or komb my hair until di three weeks komplete.
Israel God still sey, “I go ponish Amon; Tebes god; Egypt with en gods and kings. I go karry Egypt king with doz wey trust am
Yes! E go sink and distroy big and fine-fine ship.
Mikah ansa, “Wetin una mean by, ‘Wetin happen?’ Una don take all di gods wey I make and my priest dey go, wetin remain for mi naw!”
Make una break di altars and skata di pilas. Make una burn di Asherah juju poles kon kut dia juju. Make una make sure sey una distroy all dia gods!
Naw, Egypt pipol beri all dia first-born pikin wey God kill and God still ponish dia juju.
Dat same nite, I go pass thru Egypt kon kill all di first-born son inside Egypt, both human being and animals, den I go judge all di gods for Egypt. Na mi bi di Oga una God.
And naw yu just dey go, bikos e don tey wey yu dey won go yor papa house, but wetin make yu tif my gods?”
Siria king go attack Egypt, but e nor go susid.
Wen Filistia pipol dey run, dem run leave dia juju and David and en men kon karry dem komot.