“ ‘Afta di sixty-two weeks, di Pesin wey God choose, go die and nor-tin go remain. Di ruler wey get pawa pass, go bring sojas kom distroy di town and di temple. Di end go rush kom like wota; e go bring war and distroshon, just as God plan am.
With en wayo, e go prosper as e dey lie and deceive pipol. E go dey bihave anyhow kon distroy many pipol without sey e first warn dem. E go fight and win kings wey get strong pawa, but e go skata wen nobody tosh or fight am.
Bikos una dey boast sey una don follow deat and dead body enter agriment. Una dey sure sey wahala nor go near una wen e kom, bikos una bilive sey una lie-lie word go save una.