Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Amos 1:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Amos sey, “God vois bi like lion own from Mount Zion; en vois for Jerusalem bi like tonda nois. All di trees and grass wey dey Mount Karmel, dry finish.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Amos 1:2
23 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

God vois bi like lion own from Mount Zion; en vois dey make nois from Jerusalem and di eart with di sky kon dey shake. But God go defend and protet en pipol.


“So, Jeremaya, make yu tell dem evritin wey I tok. Yu must tell dem sey, ‘Like lion wey won attack, na so too God go shaut from heaven! E go shaut for en pipol from en holy place. E go shaut like pesin wey dey mash grape wey dem won take do wine and evribody for di world go hear am.’


If dem hide on-top Mount Karmel, I go find and katch dem. If dem hide for bottom sea, I go kommand di wiked animals for sea make e bite dem die.


Na how long awa land and di grass for di farm go dey dry? Awa animals and birds dey die, bikos of dis pipol wikedness! Pipol wey sey, ‘God nor dey si wetin wi dey do.’ ”


God dey go fight war like strong soja; E dey ready to fight. E go shaut. Yes! E go shaut for war kon distroy and win en enemies.


God kommand di river and e kon dry wons; E make all di river dry rish groun. E distroy Bashan and Karmel land and all di trees for Lebanon, dry finish.


God vois bi like tonda as E dey lead en sojas wey nobody fit kount. And doz wey dey obey en kommand, many and strong well-well. Di day wey God choose go great well-well, so na who go fit survive am?


I go attack una like bear wey en pikin lost kon tear una to pieces. As lion and wiked animals dey distroy tins, na so too I go distroy una.


I go take Israel pipol go back to dia land. Dem go chop from Mount Karmel and Bashan. Dem go chop beleful for Efraim hill and Gilead land.


“Judah dey mourn and en pipol dey die anyhow; en pipol sleep for groun dey kry. Yes, Jerusalem pipol dey kry for help.


Di desert go sing and shaut bikos e dey happy; e go fine like Lebanon mountins. Di soil go dey good like Sharon and Karmel farms. Evribody go si God glory, en greatness and pawa.


Di land don dry and nor-tin dey inside again. Lebanon forest don dry finish; Sharon valley bi like desert naw and di trees for Bashan and Karmel mountin don dry finish.


Wen king vex, e bi like lion wey dey shaut; to make am vex, mean sey yu won kill yorsef.


E get one man for Maon and e dey sell for Karmel town. Dis man get money well-well; e get 3,000 sheep and 1,000 goats. Dat time, e dey barb en sheep hair for Karmel.


Nashons don skata and dia kingdoms dey fall! God shaut like tonda and di eart kon bigin melt!


‘Before-before, di profet wey tok before mi and yor time, don sey: “War, honga and diziz go kom many nashon and kingdom wey get pawa.” ’


I go shaut like lion kon fight my pipol enemies, den my pipol go follow mi. Dem go rush kom meet mi from west.


Oga God, na Yu I dey kry to, so make Yu kom help us! Di grass and trees don dry rish groun, bikos fire don burn dem.


God vois get pawa well-well; en vois get glory.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka